I was driving down the street at Alausa Road, having just finished answering a call when a police man suddenly opened the passenger door, entered and jammed it. As usual he wanted “something” from me for calling while driving…Then suddenly he saw the big Rothweiller dog-Jackie at the back-seat with tongue stuck out, spittle dripping and fangs barring, staring fiercely at him.
POLICEMAN: [Shaking] Ah! You carry dog?
ME: [I bone face] Yes i carry dog, dat one na offense?
POLICEMAN: [Feeling uncomfortable] Na where una dey come from?
ME: From hospital
POLICEMAN: Ehen! you sick?
ME: No, na person wey d dog bite we go c, d person almost die sef
POLICEMAN: [Terribly shaken by now] Ehen! but why d dog dey shake head like dat?
ME: Na so im dey do if e wan bite person
POLICEMAN: and d dog know you?
ME: Yes nah, no be my dog?
POLICEMAN: [Sweating] This your door, how you dey open am?
ME: how you take enter?
POLICEMAN: Abeg! Na since i dey try open am but e no open[The dog was now getting impatient and gave a small growl, it’s tongue almost touching the policeman’s left ear
POLICEMAN: [Now sliding forward] Oga i take God beg you, open the door for me make i comot, i no go collect anything from you
ME: how much u go pay me?
POLICE: Ah! I neva hustle anythin since monin, na only 1k dey wit me.
ME: U neva redy,(attemptin to releas d dog.
POLICE: ok ok ok ok ok, e reach 2k, d oda 1k na my wyf own bt I go giv u join(now clos to tears as d dog was becomin rily impatient n getin redy to atack) Oga I be……g sory fo me take d 2k make u open d door plsssssss
ME: oya bring am(colects d 2k n alows him out of d car)
POLICEMAN: God punish you idiot, e no go ever better for you and your yeye dog, wicked man
bride2mom